2026 World Cup Qualifiers: Super Eagles No Fit Fly Pass Zimbabwe, South Africa Show Benin Pepper

Zimbabwe hold Nigeria for 1-1 draw on Tuesday for 2026 World Cup qualifier, scatter Super Eagles plan to waka go di competition.
Nigeria miss chance to grab full three points as Zimbabwe knack last-minute equalizer for 1-1 draw inside Group C World Cup qualifier wey shele for Tuesday.
Victor Osimhen don give Super Eagles lead for 73rd minute with correct header from Ola Aina cross. As e be, e don sure say Nigeria go carry three points until Tawanda Chirewa knack goal for 90th minute, waka pass defenders and use small touch push ball under Stanley Nwabali.
Di match wey dem play for Godswill Akpabio International Stadium,Uyo , see Nigeria hold ball pass and create plenty chances. Tolu Arokodare, wey enter for Samuel Chukwueze inside 59th minute, help build di goal. E hold ball well before e pass give Aina, wey send better cross wey Osimhen use head finish work.
Super Eagles miss better chances to increase di lead. For 83rd minute, Wilfred Ndidi waste clear chance as e fire wide after Moses Simon give am correct pass. Few minutes later, Osimhen sef comot because of cramp, and Victor Boniface enter replace am.
Zimbabwe nearly equalize for 76th minute as Walter Musona shot jam crossbar after wahala between Nwabali and e defenders. But di visitors finally find their goal inside stoppage time, as Chirewa use Super Eagles defensive error collect one.