“Dem Fit Go Hell” — Ribadu Para for Canadian Embassy as dem Deny Defence Chief Visa

Nuhu Ribadu, wey be National Security Adviser (NSA), don vex for Canadian embassy sake of say dem deny Christopher Musa, wey be Chief of Defence Staff (CDS), and some oda military officers visa.
Ribadu yarn dis one for Abuja on Thursday during di first annual lecture of di National Association of di Institute for Security Studies (AANISS). E talk say di North American country “fit go hell”.
E dey react to wetin di CDS talk, as Musa explain say him and oda top military officers suppose dey Canada for one official event on Wednesday, but dem no gree give dem visa.
Musa talk say di Canada event na to honour war veterans, and di visa denial don show say Nigeria gas stand on im own, stand strong as nation, and make nobody dey take di country for granted again.
“Every disappointment na blessing. Yesterday, I suppose dey Canada. Di event na to honour our veterans, di ones wey wound for battle, and we suppose dey there,” Musa talk.
“Dem invite us with our team. Half of us don go, but di oda half dem deny. E pain well well.”
As Ribadu hear di mata, e no fit hide him vex, e come hail di CDS for talking about di issue.
“Thank you for di courage to talk say Canada deny una visa. Dem fit go hell,” di NSA talk
“Even though e pain and e disrespectful, we still be peaceful and strong. I agree say di time don reach to fix our country. “Na still another reason why we go work hard to make Nigeria beta,”. Ribadu add.